Why na 9ja need crypto pass.
Finding the other benefits crypto offers asides making profits
My people, time don reach again make we sit down yarn.
Today, I go like talk about the many benefits wey dey in using cryptocurrency.
Fear not, thou shalt not end up in the trenches.
The first time wey me self sabi about this crypto thing, na the trading aspect I first sabi that year, everywhere you go dey see "cashmoney xchange", "baddest boy exchange". First of all I dey uninterested because I dey see as BTC dey carry comrades go trenches on a steady
Help me, help me, e dey carry me go where I no know.
and unfortunately na this aspect many of us sabi. Most of us think say crypto na money making scheme and you no lie but at the same time, e no be total truth.
All of us go agree say Nigerian banks don use our eyes see pepper at one time or the other, make we now see how crypto dey try help for this matter.
Charges
I sabi say one comrade somewhere go just talk "arrrgghh" now, I swear I fit relate. E fit be that last 1,100 wey you don reason say you go use run chow for night then these guys just sharparly run you streets, commot stamp duty charge of #750. You go be like SAPA 1 Tomiwa 0.
But then e no end for stamp duty na. Banks dey deduct money when you use ATMs (at least not on every withdrawal anymore), if you dey receive alerts through SMS, dem go deduct your money, for every USSD transaction nko, dem dey commot money too.
In the case of crypto, of course Dem dey remove money too but na for only the times you perform your transactions, no account maintenance charges, SMS charges and whatever.
The amount wey dem dey remove dey depend on the blockchain wey you dey use, for the sake of this matter, reason blockchain as bank.
If I wan send $5 (about #3,000) now to my somebody ehn, normal banks go charge #10 if I do transfer but on the other hand, if I dey send the same amount in BUSD ( na the same $5 but in cryptocurrency) using the Binance Smart Chain (remember say I talk say make we reason am as bank) you fit pay up to #20 as charges, the prices different for several blockchains, some dey cheaper, some dey more expensive.
You fit say "but na 2X be that na" true but then we go soon see why e pay apart from say na the only charge be that.
Spending Limits
Na another big wahala be this.
How person go dey tell you how much of your own money wey you fit spend when dem no be all these housmaters/mistresses wey we get that time for boarding school.
Depending on the kind account wey you open, you get your limits.
The first time wey I open bank account na student account I open, I feel say na because say I use student ID that year. E reach time make I pay for my accommodation, my mama send me 55K, if you be student or former student of First and Best, you go sabi how accommodation portal dey sharparly close. Na so I try pay online e no work, I go ATM go withdraw, ATM dey yarn me okoto
Is this playing, what kind of playing is this?
Me wey sneak out of class commot come do accommodation wahala, I come dey see say I gats go bank go complain.
I reach bank come dey hear say the limit on my account na 50K, I first confuse, dem come dey yarn me say I need upgrade my account so make I go bring NIN (and I no get that time). I later go use teller collect all my money. I later get room sha, glory to Jehovah.
Apart from all of this, we Sabi say the spending limit on our debit cards for international transactions na $20 per month. How person wan do am?
Crypto no get limit, as long as say the person wey you wan send your money to dey accept cryptocurrency, you fit buy anything wey you wan buy. Na your money Odogwu, spend am how you like.
Beating Inflation
For we country now, e be like say the only thing wey no dey go up na salary, every other thing dey try reach for their peak.
This time last year dollar was around #500, today it is going at #610 meaning say person wey dey earn in Naira don dey handicapped
Mo Koko gbe won ni goal goal, igba to ya, mo gbe ni over 2.5
Unlike OBO, our purchasing power no dey stand strong again like this.
For crypto, e get something wey dem dey call stablecoins. Na him people dey use guard against how BTC and him other comrades dey rise and fall anyhow. The price of stablecoins no dey change, the example wey I go use now na BUSD (Binance USD).
From the name, we fit understand say e dey derive value from dollar but na the company wey be Binance dey issue am.
The koko of this story na say, the price of 1 BUSD dey always equal to $1, so e mean say if you get 50 BUSD, for hand, na $50 be that.
Now take your salary, convert am to dollar, if e too small, no vex better days ahead comrade. Now, imagine say for your place of work, Dem dey pay you in BUSD, you go see say as the price of dollar dey rise like puff puff wey Dem put yeast inside, na so your purchasing power go dey move up too. So like OBO now, you don stand strong.
Make my tori no too long, I go sharparly run over other benefits wey crypto dey offer us.
You remember our popular EndSARS movement wey we do out of genuine love and respect for this country, you remember how Oga meffy talk say make dem ban accounts of some people? You remember how we port go Bitcoin and we come fit able run some things? Na the freedom wey crypto dey afford us be that.
If you don try send or receive money from obodo yinbo before you sabi how big the wahala be, how e dey take time before money go land for hin destination but with crypto everything na sharp sharp. If Dem send you BTC now from anywhere for this world, under 20 mins e go land for your dommot.
My people, with these "few" points of mine, I hope I have been able to convince you and not confuse you that crypto is worth the try.
Till we meet again.